Hot topics close

Solar eclipse 2024: 10 tins you need sabi about solar eclipse 2024 ...

Solar eclipse 2024 10 tins you need sabi about solar eclipse 2024
Afta dis year, di next time total solar eclipse go dey visible for North America go be 2044.
Total eclipse in North America

Wia dis foto come from,

8 April 2024, 07:49 WAT

New Informate one hour wey don pass

Eclipse fever don dey build and millions of pipo for North America dey hope to spend around four minutes of total darkness as di Moon go block di Sun light on Monday.

For some, those precious minutes go be opportunity for often impossible science experiments - one chance to sabi di secrets of our universe.

Total solar eclipse na better experience, Kirsten M Ellenbogen, wey be sabi pesin in science education and president & CEO for Great Lakes Science Center tok.

"Here on Earth, we experience a total solar eclipse wen we dey stand in di shadow of di Moon. So na ogbonge tin wey dey happun wen di Moon appear to us here on Earth, to block di sun in di sky."

Researchers go fly rockets into di path of di eclipse, stand for zoos watch animals, send radio signals across di globe, and look into space wit massive cameras.

And you no need to be scientist to follow for dis tin.

But e fit still go wrong. One solar flare or even some humble clouds fit throw those plans into gbege.

Monday total solar eclipse fit be once-in-a-lifetime experience for many.

Preparations dey go on for cities and towns wey fall path of totality as visitors across di kontri cplan to try see di uncommon celestial event.

Some schools for Ontario and Quebec no go open on 8 April and some pipo don take one day off work.

Sake of caution, Niagara region wey dey expect thousands of visitors, don declare state of emergency.

Here na 10 tins you need sabi about di eclipse

Total solar eclipse dey occur wen di Moon go between di Sun and di Earth, blocking all sunlight

Wia dis foto come from,

Wetin be solar eclipse?

Solar eclipse dey shele wen di moon come between di earth and di sun, cast shadow on earth, Canadian Space Agency explain.

Total solar eclipse na wen di moon perfectly align wit di Earth and sun, completely block di sunlight and cause darkness for some time.

For partial solar eclipse, di moon dey only block part of di sun as dey no perfectly align.

But any eclipse dey start and end as partial eclipse wen di sun is no dey hidden totally.

Solar eclipse dey common?

NASA say na between two to five solar eclipses of some kain pesin dey see from Earth for one year.

Meanwhile, total solar eclipse dey visible once roughly evri 18 months or once evri one to two years from somewhere on Earth.

Which time be solar eclipse?

For 8 April, di solar eclipse path of totality go pass through parts of North America.

Depending on your location, di solar eclipse go shelle for afternoon or early evening.

How long di solar eclipse go last?

While di partial eclipse for different locations go be roughly one to three hours long, di time to catch di total eclipse dey much shorter like seconds or minutes

How you fit look solar eclipse

Pipo wey dey watch eclipse suppose wear special glasses wey meet di safety requirements of di ISO 12312-2 international standard.

Sabi pipo warn say make you no use regular glasses.

You fit also look am indirectly through pinhole projector.

Di solar eclipse fit blind you?

To look directly at di sun without proper protection fit lead to serious problems, like partial or complete loss of eyesight, authorities warn.

Which eclipse glasses dey safe to use?

Warnings about counterfeit and fake eclipse glasses bin don dey show for different areas popping up.

Di American Astronomical Society get list of glasses wey you fit use.

Dis na sake of say some bad pipo fit write ISO-compliant without proper test for safety, dem add.

Di eclipse fit damage your phone or camera?

Di lens of your phone or camera as well as your eyes dey concentrate sunlight into one spot and fit cause damage, sabi pipo tok.

Wen be di next solar eclipse for North America?

Afta dis year, di next time total solar eclipse go dey visible for North America go be 2044.

Wetin be lunar eclipse?

Lunar eclipse dey happun wen full moon and di Earth position between di moon and sun, block sunlight so e no go reach di moon surface.

Similar shots
News Archive
  • Toulouse vs PSG
    Toulouse vs PSG
    Toulouse FC 1-1 Paris Saint-Germain: Kylian Mbappe scores ...
    19 Aug 2023
    8
  • Pat Ugwu
    Pat Ugwu
    Tragedy hits Nollywood again as actress Pat Ugwu dies suddenly
    5 Feb 2025
    4
  • Tina Turner
    Tina Turner
    Breaking: Tina Turner dies at 83 in Switzerland
    24 May 2023
    9
  • Spain vs France
    Spain vs France
    Spain vs. France prediction, odds, start time: 2024 UEFA Euro ...
    9 Jul 2024
    17
  • Valeria
    Valeria
    Valeria season one ending explained as ‘Spanish Sex and the City’ proves a hit with fans
    11 May 2020
    1
This week's most popular shots